Ye pa, E gba mi o – Nigerian Army Brigadier-General captured by “Terrorists” and later murdered
Ipemndoh dan Iyan PhM Commenting on https://www.facebook.com/share/1ABvyoYGFd/ “Terrorists” dem capture Nigerian Army Brigadier-General and behead am? Not beheaded? Did I not read somewhere that he was? “Social Media Fantasy,” a bi? Never mind. “Terrorists” capture am, sha? Na im bi di Point, now.? “Terrorists” seize Army Brigadier-General of Nigeria, di Contiri wey dem say bi number tiri powerful fo Africa and 31 st fo di World https://share.google/W0Xk0WeE8r3cWmEn2 ? E ma tan Ara yin. Anyway, no bi total Humiliation bi dat? “Terrorists” snatch Brigadier? Nigeria's Military dey useless, Man. Na only to chop (steal) Money di top Brass know, and to grow fat Bellies. Okay, me too, get fat Belly, but no bi sey aa dey steal Money o. Na careless living; unhealthy living, consuming too much in one go, nah. Aa wan bi Camel, but na only Water Camel dey store, nah, and Camel no dey fall ill from doing so, sugbon, Person dey fall ill from overeating o. As fo di ...